5 days ago
Nobody survive afta plane wey carry 48 pipo crash for go down for Russian far east
Russian officials say 48 pipo na im die wen one Angara Airlines plane go down for one thick forest for di far-eastern region of Amur.
Di Antonov An-24 plane, wey carry 42 passengers and six crew bin comot for Blagoveshchensk close to di Chinese border and just disappear from di radar screens as e dey approach Tynda airport, officials tok.
Russian civil aviation helicopter den see fuselage wey dey burn from di plane on a remote hillside about 16km (10 miles) from Tynda.
Amur regional governor Vasily Orlov say five children dey among those on board and e don declare three days of mourning.
We dey updates dis tori